You are viewing a single comment's thread from:

RE: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin)

in #wafrica6 years ago

Akwa Ibom nor follow at all for this matter. Na only Ibibio and good English dem dey yarn here. Dey nor sabi catapult pidgin at all. Even the small ones wey open eye for the matter sef nor sabi am wella. Their pidgin dey sound like good English mixed with Ibibio.

As for Anambra, na Igbo dey reign for there. Pidgin nor too follow. Na only for Onitsha dem dey speak small pidgin based on Asaba influence and based on say strangers boku for there. So Onitsha nor too follow up. Even Asaba sef, na Waffarians dey spoil that town. Normally, na Igbo dem dey yarn but Waffi boys don change am follow them. Some Asaba people don even get Warri tongue now sef.

For Bayelsa matter ehn, Yenagoa na correct pidgin area. The people wey get the town na Epie/Atissa dem dey speak normally but Izon people and Ogbia people plenty for the cabal so na pidgin naim dem take dey control their matters for there.

As for Cross River, na Ogoja/Ikom/Obudu people get am. Their langua for there na konk one. Nor play o. If original Ikom man yarn pidgin for you, your head go roll like ludo seed.

Highest pidgin sha na Warri. Area!

Sort:  

Correct yarns Correct guy Na so.