Steemit Logo done dey different from steem logo from now

in #pidgin-english7 years ago (edited)

[New Logo na steemit the old one na for steem.]
Screenshot_2017-11-01-10-54-00-1.png

I troway salute for all my oga dem wey dey read my post.
Make i use dis big oppotunity wey i get now take wish everybody wey dey here Happy New Month I dey wish all of una betta-betta thinx wey dey dis world and all the betta-betta thinx wey follow steemit come, but make you no forget to thank God wey dey give you life.

As i wake up dis morning i see big-big change wey enter steemit, sotey the change even enter the logo, i come begin wonder weda na happy new month dem dey wish us, abi no be steemit i dey so?. I come enter our steemit whatsapp group come raise alarm give dem wetin i jus see, dem sey na so dem see am ooo, person even ask for the group weather na sell dem sell steemit? but no body don get the answer by dat time.

Till i waka jam dem @steemitblog post, na there i come read everything wella.

Dem say Law wey dey cover Person handwork make another person for no go copy-copy am dey cover the new Logo ooo.
Dem say as from today make anybody no use dis new logo as we been dey use the old one take do anything like before, own. like use am do billboard, use am do flyers, put am for cloth, edit am or any how play
unnamed (2).pngimages (2).jpg
Dis old logo na Steem logo he be now, no be Steemit logo him be again. Dem no stop you to use steem logo do wetin you like dem say na free, no umbrella wey dey cover am.! Just as this people take use am.
DQmeGJNo2HsxjJi2sUNB723nMBk1MgiaoVQu3gBgY6hV2cw_1680x8400.png
DQmR7o6PfhXg7eafJDz2oAMJvNkMDSF8XhZYbvFy5iJW2q8_1680x8400.jpg

But no try use dis new steemit logo do am oo, If you won do something like dat with dis new logo you go write or waka go collect permition from dem steemit oga dem hand.
If you no collect permition and you go try am My hand no dey am ooo, Wetin you see Na you go still use your head carry am ooo.
If you no understand my language waka go read am here https://steemit.com/logo/@steemitblog/the-new-steemit-logo-is-here

I Thank you Well-well say you read my post.

If you like wetin i write Support me with any how upvote

IMG-20171012-WA0016.jpg

Sort:  

Thank you well well for how you take transgbawe the plenty plenty Oyibo them to wetin person fit grab. E sweet me as I see you dey do your

hahaha, you too dey make me laugh

Nah naija we be

Hi, ionlyspeakpidgin! I just resteemed your post!
I can also re-steem and upvote some of your other posts

Curious? Check out @resteembot's' introduction post
PS: If your reputation is lower than 30 re-blogging with @resteembot only costs 0.001 SBD

Whatever @resteembot resteems, I resteem too!
I am a new, simple to use and cheap resteeming bot
I will automatically resteem posts resteemed by @resteembot until 2017-12-26 00:00:01 +00:00
If you want to read more about me, read my introduction post.

Brotherly follow and upvote a sister nah....make we rapol wella

hahha. i gbadun you.