TRANSPORT MONEY PALAVA

in #naijapidgin7 years ago

My country people una well done on. We don come again with another matter.

Today we want make we shook mouth for this matter as e concern boyfriend and girlfriend or man and woman.
imageimage
We know say when man meet woman for social media and they come dey yarn dey flow well, the next thing wey suppose happen na make they see abi? So na the matter we want align today so.

Na who suppose travel go meet the other one? Na man suppose travel go meet woman abi na woman suppose go meet man?

If the woman dey go meet man e good make man give am money wey she go take enter motto go meet am abi na woman suppose use her Moni enter road go see the man?

My people make we align for this matter

20% of this post payout go go to the person wey him comment get enough people dey follow am argue inside and the one wey get plenty upvote.

Na @zizymena write this one for @naijapidgin.

If you go like join us for Telegram, click here

image
@mittymartz na im design our avatar.

Sort:  

As e be like this, na man supposed go meet woman even if the woman dey Atlantic ocean na him first toast am nau. So na him supposed Waka the waka go meet am and he no suppose carry empty hand go, he fit buy am something or carry small change wey he go take flex the babe.
But if na the babe Waka go meet the Bobo, the Bobo gas give the babe the raba wey she use come and go back house and even given am extra make she use am take chop gala and Pepsi for road

as me i take see this matta eh you know say this thing wey dem dey call love e strong well well and if dem body don dey sweet dem e no really matta who go see the oda person, when dem arrange d parol any body wey get chance and money fit run am base on how them two agree. e fit be say work no go allow the other person so any of them wey get chance fit go see the other person and anybody wey get the money fit spend am that is if them really like themself sha.
nah before before them our mama dey do arrangee love by now everything don change o.
wetin i dey try talk b say everything nah understanding

So if you meet woman you go allow am use her Moni come see you for the first time? I go wait make women put mouth for this matter

Leave am naa, make he dey deceive himself. Na person like am go grow gray hair dey wait for woman to come visit, meanwhile she don change mind the minute she hear say na she go sponsor her trip to and fro. Unto say Wetin? That kind love no dey again. Adam and Eve forget am for Eden wen them dey comot.

My own na say. Na me dey first visit woman. E dey make d woman warm up to you, she no go reason you as stranger again, e dey even boost her warmness to you. If babe come, na to give her anything wey you get, e dey give man respect pass anything ooo.

Correct! Chop knuckle, my guy!

U be sabi girl too. How you dey?

This kain thing go sweet pass if the woman go meet the guy, because if she de stay another town na to pass the night make the talk last wella. But as e be now wey plenty people don de talk say the area no de smile again money ritual dem full everywhere, e better make d guy kuku go visit d lady

Zizi come here

Make I ask you if me and you meet online now and if I give you money you go Come?

And me I no like the yeye idea of online package... As e de hot na make we de see ourself or we no de see and dat one no fit work for me
We fit de do online dirty talks and all and no be real

Talking about travelling to meet I no de go ooo and I no de give any girl money to come but I fit reason her transport to go back and I go don collect watin pass that transport for her body
You feel me zizi

I no b bad person but I true talk because na watin every guy go do (any girl wae travel come wan collect banku)

So if you invite babe come your house you get plan to collect something from her body? You na bad nigga o

Na normal stuff

No be by inviting the babe
The matter na say for her to travel long distance come she no suppose go back thesame

Guy u funny ooo but I reason with you sha

Thanks you bros

Una thank you but i go like talk true for this one make we no bend mouth go one side.

No be by force make e be the boy or girl by force. Na agreement go determine who go come.

If na the guy place na im comfortable and them agree am or if na the babe place, them go sha agree.
But if everything set for the two sides, then na the guy suppose go because na him be the man so he gats show say him value the babe.
Except say matter bend for one side, dem go come agree.
Una doh oo. 🙌

This mata na delicate issue regardless of the level on which the two of them don dey.

I no fit advice a lady to carry her to leg go waka greet a man or travel go meet a man on their first meeting

The reason behind my own comment be say some palavar fit show, like either the man get secret agenda for the lady as the environment wey we dey no allow for trust.

The best wey i dey expect for this issue is that the lady must to decide on the location wey the una two of them go meet. Make palavar or yaw go gas if dey lady travel.

We don see lady wey don encounter problem due to travelling on a first date.

I go prefer travel go her side and settle all the bills wey we go spend

I understand you my padi but asper guy if d girl get roommate where you go stay you go just end up spending more money but if she come your side one na only tfare you go spend and if you get room mate u fit tell am make him lock up and him go understand

If she get room mate she no fit tell you to come her room, she for don arrange another place. The mata be say we suppose be security conscious. If yawa gas when the girl dey your side na double whala be that but once the girl decide then na for the guy to spend be that.

The thing na first meeting naw and i no expect the guy go wan become mario there. After the first meeting then things fit take another shape from there.

More so, if you go her side the expenses might not dey too much. If na person wey love she go dey consider not to demand from you and she might even take care of you than expected.

I don dey this scenario before broda me

I greet una o my country pipu.
This Na Beta topic to talk about o.
but before I chuk my mouth for the matter make I greet @zizymena the person wey do the arrangee.
hmmm.
this thing we dey call love get as e b. If love dey between the two people, wey be the boy and girl any of the party fit travel. Money no suppose be the barrier for where love dey. But if Na the girl wan go see the boy, the boy suppose do arrangee of transport for the girl. Except the girl say no.
my naija pipu, if love no dey inside the matter, I no advice any girl to travel far just to go see social media lover.

Well comment and upvote aside(which I know I might not even get in the first place), I think say anyone wey need money suppose get money. E dey like one joke wey dem dey ask "between husband and wife who suppose dey cook?? Person con reply say na d one wey hunger wire am" so you see, like my pipo d talk m "na u sabi as e d scratch you for body". On a level note either of them fit dey free, so anyone that's free y not?? Also Tori of transport back dey very important because I don witness wahala no be once nor twice. Abeg abeg before person leave him house con d visit u Biko do sontin like "contract agreement" ..... If u d come see Wetn n Wetn n Wetn go dey here o no go d form big big man before you sabi am una d drag trousers for roadside.... I know say plenty Nigerians been Don watch the "asthma video" wey happen infront of UNIUYO gate. But on another aspect I think say anyone responsible person wey wan go somewhere suppose keep him transport money just to avoid embarrassment .

Na d woman suppose go see d guy. E get why. Based on d transport money mata, i feel say na the man suppose settle am based on say na the man dy invite her come. Na normal thing do

Wetin be the why? Talk am come out.

Based on say na e be chairman na. The guy fit still dy go see d girl once in a while sha all na based on d agreement of the relationship